Emir Aminu Ado Bayero out, Sanusi Lamido in as Kano goment sign new emirate council law

Kano State goment for Nigeria don remove Emir of Kano, Aminu Ado Bayero and reinstate Sanusi Lamido Sanusi as di new Emir.
Di goment also remove di oda four emirs of di state.
Govnor Abba Kabir Yusuf sign di new law wey Kano State House of Assembly pass, wey dissolve all di five emirates for Kano and remove dia emirs.
Dis one follow di state assembly approval to dissolve di emirates and remove di five emirs from dia positions, to return to di single emirate system wey don dey for ova 900 years for Kano.
Dis development happun less dan seven hours afta di Assembly approve di law wey cancel di 2019 law wey former govnor Abdullahi Umar Ganduje make, wey create five emirates for Kano.

Categoria:
Notícia 
Escrito por:
Abubakar Idris
Localização:
Nigeria